Na foolishness to close church because of Coronavirus - virologist
Na one oga for virus things wey im name na Paolo Gulisano talk this thing when him dey talk to LaFedeQuotidiana.it (March 3).
Him talk of something wey oyibo dey call Coronavirus psychosis. Wetin e mean na say people don dey go psycho because of Coronavirus. Dem no dey gree reason again.
Where you fit get Coronavirus pass na for subway, under bridge, supermarket and betting shop but no body dey talk because those kind place dey bring money for the person wey get am and for government.
The man, Gulisano talk join say normal ordinary flu dey kill people pass Coronavirus.
We just dey make this thing powerful by ourselves.
#newsLcevylbyll